WAEC Results 2023 latest WAEC seize many candidates results

WAEC Results 2023 latest WAEC seize many candidates results, see how to check 2023 result;-  But results of 170,146 candidates, wey be 10.9% of di total number of candidates wey write di exam wey end for October 8, 2023 , still dey wit di exam body.

Dis means say thousands of candidates no go fit see dia own now sake of WAEC don seize am.

According to di statement wey West African Examination Council release, dem seize dis 2023 results sake of say e connect wit case of exam malpractice.

Dis WAEC WASSCE Exams start August 16 and end October 8, 2023

WAEC say di tin wey dey worry dem be activities of rogue-website operators and some oda social media platforms.

Dis na those wey dey post exam questions online immediately after di paper dey administered, WAEC explain for statement.

Dem also complains of pipo wey dey use the phone for exam hall despite say e dey banned. WAEC add say some schools dey arrange organized cheating, plus oda big matter.

Di exam bodi say dem dey investigate all di case and reports of di investigations go dey presented to di right Committee of di Council to reason am kia kia. Di Committee decision go dey communicated to di affected candidates through dia schools.